Pregnant Hypertensive Women Dey Likely to born Boys.

Hehehe… oga-madam, se una don don hear say pregnant hypertensive women with high blood pressure dey likely to get boy pikin as scientists talk say those people wey get hypertension because of diet wey get plenty salt, drinking and too much smoking, dey more likely say, people like that go get boy pikin, according to one latest research, and while the reverse too, na true.

E get some ogbonge researchers from ogbodo Mount Sinai Hospital for Toronto, wey examine whether blood pressure get role to dey determine sex ratio of pikins.

Dem been recruit women wey dem dey plan to get pikin for the nearest future.

Dem come assess these women, as at before and during the pregnancy, come measure their blood pressure, glucose level, triglycerides and cholesterol.

Dem come discover say systolic blood pressure before pregnancy dey higher for women wey get boys, as pikins.

These findings come prove to dey very correct, even after when dem account for age, smoking, BMI and education paro.

E get one ogbonge study author Dr Ravi Retnakaran wey talk say; “The sex chromosome of the fertilising sperm dey determine the sex of the foetus for human beings dem.

Experts come warn say the findings “Fit dey problematic and potentially dangerous for populations, wey fit favour the birth of one sex pass the other”

“Maternal blood pressure before pregnancy na one factor wey people no sabi before,  wey fit dey  associated to make person dey deliver either boy or girl pikin.”

For that study, wey dem published for American Journal of Hypertension, him warn say this fit make mother’s blood pressure dey artificially manipulated.

Before e be say dem discover the ultrasound wey dey provide ogbonge answer, people don dey use plenty old wives tales and tori to guess the sex of unborn pikin dem.

Some people think say if dem lowly carry one pikin, say e go be boy and if the girl dey  more likely to sit higher for belle, say e go be girl.

E get another myth and tori wey yan say if dem hold wedding ring above the pikin dem come begin dey swing am for circle, say na boy e go be and say if the ring move side to side say na girl e go be.

Na wetin you feel for this kain research??? Abeg share your thought for these kain research…

LEAVE A REPLY