34,000 children experiencing malnutrition in Zamfara

sigh! Malnutrition dey suffer our pikin dem o…This pishur just show how this small pikin dey suffer from acute malnutrition, and how dem dey make serious effort to stabilise the pikin condition after when dem admit am go one local hospital.

Chai!!! But the kain strong thing wey malnourishment dey do small pikin dem eh! My mouth no go fit talk am finish.

In fact, dem record over 34,000 cases of child malnutrition last year for about 6 out of the 14 local government area for Zamfara State, na the state Nutrition Officer, Alhaji Samaila Bakwai, talk this one.

More also, the way wey acute watery diarrhoea cases dey rise for crowded urban areas, too, dey really put malnourished children at grave threat from cholera.

E get this workshop wey the United Nations International Children Endowment Fund, UNICEF sponsor for Gusau, in collaboration with the State Primary Healthcare Board.

For that workshop, Alhaji Bakwai shift blame give the high figure wey dey for poor feeding and lack of nutritional diet.

According to am, “a lack of attention to the issue was one of the big holdups, lamenting that out of the N100 million budgeted for nutrition last year, only N5 million was released.

LEAVE A REPLY