Na wao, hypertension no be for here again o…World Health Organisation, WHO, don reveal say 46 percent of adults for African region countries dey hypertensive, the study reveal say the result of adult male wey get systolic blood pressure plenty pass adult female wey dey hypertensive.
The report talk say Nigeria dey top the list for males and females with the highest percentage of adults wey dey hypertensive, other countries wey follow nag HANA, Seychelles, Sao Tome and Principe and Cabo Verde.
The gender comparison data don rate Nigerian adult very high with 51 percent for males and 49 percent for dem female wey dey hypertensive, Ghana with 41 percent male and 38 percent female.
“Seychelles get 44 percent male and 36 percent female; Sa Tome and Principe get 41 percent male and 36 percent female while Cabo Verde record 44 percent male and 34 percent for female dem.” The global averages for the number of people wey dey suffer from the condition na about 40 percent, according to wetin WHO talk.
WHO dey blame the way wey urbanization dey take increase and the rate wey unhealthy lifestyle dey take rise…
The study don reaffirm say hypertension don tanga, come remain the major palava, as he percentage of adults wey dey hypertensive dey range from 16 to 40 percent, while the median na 31 for 36 STEPwise surveys wey dem conduct for that region
The five countries wey get the highest prevalence for hypertension be Seychelles (40 per cent), Cape Verde (39 per cent), Sao Tome and Principe (39 per cent), Ghana (37 percent), Niger (36 per cent) and Nigeria (35 percent).
So now, the five countries wey get the lowest prevalence of raised blood pressure na Mali (16 per cent), Eritrea (17 per cent), Democratic Republic of the Congo (Kinshasa, 17 per cent), Cameroon (17 per cent) and Togo (19 per cent).
High blood pressure dey always dey too late to detect, as e be say na silent killer. WHO talk say if people lifestyle no change, plenty people for Africa fit die from chronic illnesses, including diabetes and cancer, than other infectious disease come 2013.
The report author, Abdikamal Alisalad, talk say the level of unhealthy habits for plenty African nations don come like wan big shock.
“We just dey surprise because we been dey think say we no go see this kain current situation, as we been dey expect am in the next 30 to 40 years from now”.
Him come talk about how non-communicable diseases and changes dey increase for developing societies.
“People dey move commot for rural areas, dey waka go urban and metropolitan areas. Those wey dey collect middle- income just dey increase, and life expectancy sef dey also grow, too.
Communicable disease dey very costly, so na every country business to helep support prevention campaigns.
Uncontrolled hypertension or high-pressure fit result to plenty serious health gbege, even memory loss, heart attack, brain damage, eyes damage, stroke, atherosclerosis and kidney damage sef…
I’ve been surfing online more than three hours today, yet I never
found any interesting article like yours.
It is pretty worth enough for me. In my opinion, if all webmasters and
bloggers made good content as you did, the internet will be much more useful
than ever before.
This website was… how do I say it? Relevant!! Finally I’ve found something which helped me. Thanks!