Aisha Buhari Vows To Tackle Health Challenges Of Nigerian Women

My Lovely readers, how una dey o? Oya make una come see wetin Aisha Buhari talk concerning health challenges for our women and children dem…

As wife of the president, Her Excellency Mrs. Aisha Buhari don vow say she go tackle health challenges wey dey affect women and children for the country.

Hajia Buhari talk this one, as she dey commission borehole wey her project Future Assured donate to Gofinda community near FCT.

However, she dey call on every Nigerians to make sure say dem use water wey clean and wey dey safe for drinking so as to fit avoid water borne diseases

Mrs. Buhari urged all communities to helep themselves take charge of their health by promoting filtering for areas where be say clean water na big challenge.

The former Deputy Governor of Plauteau State Mrs. Pauline Tallen wey mark attendance for the First Lady urged all organizations and philanthropic individuals to photocopy her gesture for other communities.

She talk say na the surest way to improve the health of people wey dey communities.

My people se una don hear now? Abeg make we follow the full steps of our Madam at the top.

You get something to say?

LEAVE A REPLY